Story of a Survivor - Season 1 - Episode 11

Episode 5 years ago

Story of a Survivor - Season 1 - Episode 11

So na wetin you de do here? You no look like
craze Man nah! I said.

I no be man o! I be Boy he said, I be ten years
old Boy o!

I drew closer to take a better look at his face
and I almost screamed but I remembered my
Father’s advice in my dream so I quickly used my palm to close my mouth so as not to
scream out.

Na wetin you dey do here! I blurted.

I never chop anything since morning, so I thief
my senior Brother Money go buy wetin I go
chop! He replied.

I no understand you o! I queried, You no dey
chop for house or wetin you mean?

I dey chop one time a day but before I finish
work wey I dey do since morning, my Brothers
dem don chop the food wey their mama keep
for me, that na why I go search Nonso pocket,
the ten naira wey I see there, I carry go buy
Bread and Akara.

He no go beat you if he no see him Money so?
I asked.

He go beat me nah! But he no go kill me!
Beating no be anything to me again o!

Everybody dey beat me any how for that
House.

Dem dey beat you anyhow for your Papa
house? Which kain talk you dey talk so nah? I
enquired.

Aunty, you no go understand, make I dey waka before dem begin to look for me.

My prayer be say make Nonso no notice say him Money dey miss this night at least make I for fit sleep without crying today. As he stood up to go I told him to wait.

Wetin be your name? I asked.

My name na Chinedu but dem dey call me
junior, he replied.

Na wetin be your Papa name?

My full name na Chinedu Junior Amadi
You dey go school so? I asked.

Yes I dey Abakpa Community Primary School, I
dey class two.

Class two? I shouted. You be ten years and
you dey class two? Why nah? I asked.

Yes nah! He said. I been stop school when my
real Papa die and my Mama Abandon me with
my Uncle when She carry all my sisters run
away. Na last year my Uncle come say make I
go start again from primary two. Bye-bye!

Make I dey run go now I beg!

Wait! Come take! I said as dipped my hands
into my Pocket and brought the bundle of cash
with me, I peeled out several notes and gave
to him.

No o! He exclaimed. You want to kill me? I beg
Aunty if you want to help me, just give me the
ten naira wey I thief make I go return am. If
dem see me with this kain money my own don
finish for that House o!

I quickly searched my other Pocket and gave
him an old ten naira note. I could not hold
back the tears. I cried as Junior bade me
farewell and sped off towards my father’s
House, our House.

Previous Episode

Story Of A Survivor - Season 1 - Episode 10

Next Episode

Story Of A Survivor - Season 1 - Episode 12

What's your rating?
0
{{ratingsCount}} Votes


Related episodes
Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 2
episode | 5 years ago

Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 2

Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 1
episode | 5 years ago

Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 1

My Flatmates Season 1 Episode 1
episode | 5 years ago

My Flatmates Season 1 Episode 1

TV Series: Professor Johnbull Season 4, Episode 2 (Campus Marriage)
episode | 6 years ago

TV Series: Professor Johnbull Season 4, Episode 2 (Campus Marriage)